BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
South Africa anti-migrant group protest against gender-based violence and illegal migration
Di anti-migrant group 'March and March' bin announce 30 September as deadline for undocumented migrants to comot from di kontri.
Africa richest man Dangote open refinery for Kenya – Wetin dis mean for Africa
As di groundbreaking ceremony for di proposed 700,000bpd Dangote Refinery dey hapun for Lamu, Kenya, here na wetin di development mean for di East Africa region.
South Africa President Ramaphosa announce four immediate measures to tackle violence against women
President Cyril Ramaphosa go address di nation dis evening on di steps wey im administration dey take to confront gender-based violence and femicide
Journalist Edward Kijanangoma become new King of Tooro Kingdom afta succession wahala
For long, di new monarch na familiar face for di East African nation, but many pipo no sabi am as heir to di throne, but as a storyteller.
'Three Nigerians killed in four days' - Nigeria govment react to death of citizens for South Africa
Di Nigerian govment dey ask South Africa to act on dis matta and arrest all di pipo wey get hand for dis killings.
Wetin we know about di 60 fresh abduction for Niger and Zamfara states
Dis na di for di latest wave for di series of kidnaps wey armed criminal gangs don carry out dis year.
Christa Pike go be di first woman wey dem go execute for Tennessee in 200 years - but her defence say she be victim too
Lawyers for Pike, wey bin kpai fellow student for 1995, say she suppose get clemency and dem for no sentence her to death if di crime bin happun today.
Why Tinubu long vacation dey cause debate for Nigeria?
Di long absence of Nigeria President Bola Tinubu, witout transfering power to im Vice as Acting President, don cause ogbonge debate. But wetin di law tok?
27 pipo die for two separate mass shootings for South Africa
Twenty-seven pipo don die inside two separate mass shootings, few hours apart for South Africa, di latest gun violence to hit di kontri.
Special Tori
Netanyahu say pilot chop arrest afta e stab co-pilot and try to crash plane wey dey go Israel
Di Flydubai plane wey take off from Dubai International Airport early on Wednesday send emergency code about two hours afta di journey start, according to flight tracking website Flightradar24.
Police arrest commissioner, 5 odas wey allegedly get hand for di beating of deputy director to death for Delta
Police arrest five pesins and launch manhunt for two suspects as dem dey investigate di death of one deputy director of Education for Delta State.
Special court for Edo say make dem kpai convicts by hanging afta Govnor Okpebholo vow to sign death warrants - wat next?
Justice Aigbona Momodu sentence di four suspects to death sake of say dem bin kidnap one woman for di Vegetable Market along Airport Road for Benin City.
Nigerian politician children wey dey contest for elective positions for 2027 election
Among dem na pikin of former presidents, former govnors and former Senate presidents wey dey seek tickets for major political parties.
Killings of twelve women for South Africa since July - faces of victims as suspected killer of 23-year-old woman kpai
South African President Cyril Ramaphosa tok say di murders na "stain on our national conscience".
'We no get issues' - Rivers APC react to Supreme Court judgement on electoral act wey fit affect Kingsley Chinda candidacy
Di APC for Rivers state say dia govnorship candidate no dey affected by di judgement of di Supreme Court.
Wetin we know as police find 28 human skulls and bones for Abia state
Police say dem find di remaining parts of human bodies for inside forest for Isuochi and Nneato community under Umunneochi Local Govment Area of Abia State.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.













































